10
Mordekai
1 Di pipol wey dey near di sea for di kingdom, King Zazes kon force dem dey work well-well. 2 Naw, all di great and wonderful tins wey e do, with how e take promote Mordekai, dem rite dem for Media and Persia kings book. 3 So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.